It is time, Ghanaian incumbents

Posted by Top_Lime1820

2 Comments

  1. [Mahamudu Bawumia ruling NPP candidate concede defeat to John Mahama](https://www.bbc.com/pidgin/articles/c99xy0mn39do)

    >Di ruling New Patriotic Party (NPP) don concede defeat to di opposition National Democratic Congress (NDC) for di 2024 presidential election.

    >Di Vice President of Ghana wey also be di candidate of di NPP Mahamudu Bawumia concede defeat for one press briefing on Sunday 8 December, one day afta di general elections for di kontri.

    >Im announcement come bifor di Electoral Commission official declaration of di presidential result.

    >Oga Bawumia concede defeat immediately afta one press conference wey di NDC hold to claim early lead for di election.

    >E say im concede defeat based on di provisional results from dia internal tallies from dia party wey show say presidential candidate of di NDC John Mahama don win di election and di NDC also win di parliamentary election, even though dem dey await final collation from a number of seat, but im believe say dat no go change di overall outcome.

    >E say im don call di candidate of di NDC John Mahama to congratulate am, Oga Mahama also confam di congratulatory call for one post on X.

    >”Dis morning, I receive congratulatory call from my brother Mahamadu Bawumia following my emphatic victory for Saturday election. Thank you Ghana,” di NDC candidate tok.

Leave A Reply